men i enjoy ur version of ps 23,bt i 4 prefer fufu and ogbonor soup.
1. The Lord na my shephard, i dey Gidibaaa.
2. E make me sidon for where betta dey flow and come put me next to stream make mai bodi thermacool.
3. E panel beat mai soul come spray am white, come dey lead me dey go through express road of righteousness sake of Hin name.
4. Walahi, if I waka pass where arm robber, 419 and juju people boku, come even join okada reach valley of the shadow of death sef, mai bodi dey inside cloth. Your rod and staff nko ? Na so dem dey like back bone dey comfort me.
5. You don prepare Egusi and Pounded yam make I chop. All mai enemies dey look waa waa. You rub me for head wit vaseline intensive lotion. mai cup na River Niger wey overflow hin bank.
6. True true, betta life and mercy go gum mai back till I quench. And man pikin go tenda for God house from lai lai to lai lai.
GOD ALMIGTHY NA YOU BIKO
AMEN
men i enjoy ur version of ps 23,bt i 4 prefer fufu and ogbonor soup.
Is good guy. Is like you like pigen english well.
Main i want to learn it
'tenda' might better have been 'tanda'; I'm sure you meant 'stand', right?
![]()
Breathe!
you are indeed a trained pigin english guru. u dey waste for searching job for naija wen God don annoint you with talent? abeg locate Julius Agwu and Co now and get started. cheers men.
.
men i feel you with your gist as regards pslam 23, keep it up. habi if job is not coming yet we need to make our teeth come out in the process of laughing. As to the last response dont fasheey job searching for naija people ooooooooooooooooo. cheers men.