No Be Lie!
This happened in a Classroom in Warri.
Teacher: You Boy, spell plantain
Boy: Whish one? The ripe one abi the unripe one?
Teacher: Shuo !! What difference does it make? Just spell plantain! Abi you wan try me?
Boy: Shuo Teasha, no be fightooo! If you fry the ripe one na 'DODO', if you fry the unripe one na 'SHIPS', if you roast am, na 'BOLI' and if you soak am come dry am na 'KPEKERE' all of dem na plantain,
so whish one you wan make I spell na?!
Tok quick I wan waka.
No Be Lie!
No One Will Know You Are Honest Unless You Give Out Samples!
@sammie and dagunro Na up if i fold my hands & allow u guys yab my place like dat & go without any injury. U no say we (WARRI)no dey carry last. Good schools stil dey warri sha at least they can stil recite twinkle twinkle little star,how i wonder what u are....... But if na for ajegunle(LAGOS),na different poem dem dey recite there; Teacher: Wasiu can u recite a poem? Wasiumo teacher ti yawere,look at d easy question she is asking me. Wasiu:IF NA ME EAT THE RICE,IF NA ME EAT THE RICE,AGBAKARA MUST TO SWALLOW ME,FIS(H) MUST TO EAT IN ME, AHAM O HO. -odeli felix,08069471437
T
Sammie take time oooo, why u dey use warri as example...lol. wetin be the name of the skool wey this thing happen ? lol. well, e funny sha...lol
felixodeli, nor mind dem, warri get good skools pass like dat.
@smartie4real OK i don chill,sammie na my guy sha but just clear sammie make him nor do am again sha,cos if i hear am? if i hear am? e don buy 4k up o. cos i know say many area (Wafarians) dey this sha and dem just dey luck up o. so just clear sammie this one o. I don yan my own.
T
No Wayo! Different strokes for different folks!Originally Posted by felixodeli
![]()
@felix odeli!
....but you forget to recite the type wey dem they recite for VGC|LEKKI|V.I.![]()
![]()
No One Will Know You Are Honest Unless You Give Out Samples!
@Dagunro Any wayo no dey there,na inside VGC i dey stay,kpako like me many 4 there too. I dey take my niece dey go chrisland sch inside there one morning wey i see this man dey shout 4 d teacher.see wetin happen. KAYODE'S FATHER: Teacher,why did u flog my son?. TEACHER:I gave kayode assignment ysterday,he ddnt do it,I had to flog him. KAYODE'S FATHER: why u flog am? dem dey flog person for wetin he nor do?.
T
I hear you!Originally Posted by felixodeli
At least no be Kayode na im talk. I believe say im papa want make im(kayode) better pass am(Kayode papa) dat na why kayode dey go chrisland school.
Afterall na you say "IF YOUR CHILDREN ARE NOT BETTER THAN YOU,THEN YOU MUST HAVE FATHERED THEM IN VAIN".
![]()
No One Will Know You Are Honest Unless You Give Out Samples!
@dagunro Yes na so i talk but if kayode wan better pass him papa,why e nor go do e assignment? na ppl like this wey dem don fail finish,dem go dey lie for their pikin say wey dem dey school na 1st dem carry. No one go even gree say him carry 2nd.
T