Bernard Enahoro or career@shell dey mad oh ... make me come all the way to Naija with my hard earned GBP540.9 (N119,000) plus all the other miscellaneous coins i spend to and 4rm London Heathrow, Murtala, Omagwa down to my crib ... plus plenty plenty gifts i buy for home people, pay hotel bills, flex for town, etc ...
... yet button me 5h as reimbursement for tp 4rm London ... see insult ...
now this bobo get the effrontery to tell me say I dey "unsuccessful at this time" ...
No be trouble Shell dey find me so?? ...
Well, make i shun and delete wetin dey my mind ... if not wetin fit that Bernard na to hunt am down, lock am inside a confined space with a 100ppm concencention of Hydrogen Sulphide until im refund me my doe ...
Abi dem tell am say na carlo-carlo i come play?? ... if im no put "reimbursement" for the invitation, i for no show ...
